webnovel

New phase

Peter say as exam don finish him full ground now...say him ready to make lot of money before him go travel,I con ask am say him dey travel,when...him con tell me say that wan nor be my business, say the one wey concern me na be the Keke...aahh Peter wan travel? Where him dey travel go and why him wan travel...him say nor be my business so I Kuku comot my mind.

Me and Peter con enter town, him dey him own Keke I dey my own...him say make I dey follow am for back we ride go one street wey be like estate,we con pack for outside near one gate, one tall guy wey fat small con come out from the gate...Peter con go meet am for the gate, he con dey point me give am..the guy con call me to come....as I reach am Peter con say na oga Kush be this my very good oga...him nor lie....Oga Kush con say Peter don tell am say na me go dey carry am from now.

Oga Kush na better person...the guy fine sha, as man I trip for another man aahh. Oga Kush go dey like John my brother age.

Peter con leave us say him get person wey him wan go carry...oga Kush say no levels... Peter con move.

Oga Kush con say my guy wetin be your name I con tell am say na Innocent,Inno for short...he con smile say levels, I like you.you be correct smallie...I con tell am say thank you chairman.

Oga Kush con ask me for my number I con tell am say I never get phone, he con ask me how I wan con take do the work without phone....as I dey wan tell am my long story he con say make I wait say he dey come back....him con enter him compound....aaahhh my heart don dey heavy me oh..ahh I go con lose this oga oh..aahh mama John and John!

As him come out he con stretch one phone for me say na iphone 6 small say he nor dey use am again say make I use am,he con ask me if I get sim, only him con answer himself with another question, "how you wan take get sim wey you nor get phone.... Oga Kush con say one sim dey inside I go call you tomorrow....

Aaahhh mama John your son don make am oh...Inno don get iphone wey I dey hear since...my joy nor be small as I dey ride my Keke wey Peter give me dey go I just dey smile cause na sign say I go make am for this Yahoo Keke work.