webnovel

I over vex

I con ride my Keke go Peter house con pack am...him don already tell me how I go dey pack am if I nor get work say him nor dey use him Keke for towns ride...me sef nor get body for that one.

Time still plenty I say make I just go my tailor shop go wait till my closing time cause I nor go fit go house myma go just know say something dey wrong.

Omo!!!!! Myma don burst me oh...as I just wan enter the shop me and myma just jam for the door...how I wan take lie this one...aaahhh

Innocent Innocent Innocent Innocent where you for dey come...I nor know wetin to talk na once I say na my oga send me,lielie lielie your oga wey find you come house say him never see you for days now. Aaahhh!

Say make mata over worse oga just come outside....when I take send you and where I send you go for more than five days now?...make whona Kuku kill me oh...na so myma drag my cloth say make we dey go house.

As we reach house she con dey ask me again say where I dey go since wey I nor dey go my tailor shop, as she dey drag my cloth na the phone wey oga Kush give me con fall from my pocket...aaahhh...the mata don double oh.... Innocent you don dey thief? Who give you phone...I con dey tell her say I nor thief the phone... myma don start to dey knack me before I know she don dey call John.

I con vex tell her my mind say she nor love me say na John she love as all the time na John, say she never ask me once wetin I want..say I nor be John and I nor go ever be like John and I nor be thief...na so she con drop her phone con sitdown dey cry...I con enter my room con dey cry too cause I never talk to myma like that before and I nor go sha repeat am again.