webnovel

Love at first sight

Oga Kush say make I dey come now say eh get work for me say make I quick..I tell am say I dey come now now..

As I drop the call na so Peter just dey look me,I con ask am say wetin happen, Peter con say nothing happen, say he just dey reason how Oga Kush take carry my matter..say just one day he give me phone and him don dey carry am for some months now.

Na I tell Peter say na grace oh...say this Yahoo keke work na for me. Say make him nor worry say very soon I go become Oga and I go buy am like three keke, Peter con say I be fool say make I dey dream.

The food nor con gree me eat again,I con tell Peter say we go see later.. Peter con say he go keep him key for under him doormat if say I come and him nor dey make I fit enter house,I con tell am thank you then move out.

I enter my Keke on am then zoom out..

As I reach Oga Kush street body just dey sweet me,my first work ,the feeling enter body.

As I reach him gate I con call am, I buy card cause I nor fit go dey knock gate for estate,him pick con say where I dey I tell am say I dey him gate him con say he dey come make I give am few minutes..I con tell am say ok.

As him come outside him come with one slim girl,she fair like am, from the way she look,either na him daughter or na him sister,the girl fine sha but I nor lose guard.

Good morning boss na so I greet Oga Kush.

How you dey Inno?..I dey fine boss man na so I replied, oga Kush con laugh...I wan make you carry my smallie go market go buy something, abeg drive well..

I con tell am say no problem.

As we dey go na so I dey look the girl from the side mirror aaahhh see beaut, shhhh...my mind just dey tell me say make I follow her talk,but I never talk to girl before, even the ones for my class before we nor dey aline, na only the ones wey want make I buy something for them na dey talk to me"Inno buy something for me na", "ok" eh don finish.

Wetin I wan even talk with her self.

I just kuku face my front dey ride my Keke oh.

As we reach the market na I con park,she con come down con talk to me say na small things she wan go buy" Jasu her voice fine like her, I nor know wetin con do me as I hear her voice...my own voice nor con fit come out...I just dey smile dey shake my head like lizard...she nor even smile she just waka leave me.

I nor know wetin happen to me as I dey inside my Keke,my heart just dey race,the thing just dey beat like person wey go run marathon, aaahhh abi na this one them dey call fall in love? Nor be for me, I dey focus....eh nor tay as I see her dey come I nor know where the smile for take come back,Inno who do you this one ?.

I con come down con help her with the things, she con tell me say I nor for worry, I nor con know wetin to talk, na so I waka back go enter my keke..the smile nor still go.

Next thing wey I hear "you too smile, you never see fine girl before" na so she con talk.

Kai I never fit even stop smile,I nor just talk I just focus on the road dey ride my Keke.

As we reach Oga Kush gate I con park, I don try my best con hard my face,even as I dey try make I nor smile like fool, the smile for my face nor get sense reach me.

As she come down she say make she go call her brother, I con tell her make she nor worry,say Oga Kush don try for me this week say na next work I go collect money,she con say no problem.

She don almost enter the gate when I con ask her if she fit tell me her name?

She con say Valerie...ok thank you na so I con talk, na I zoom dey go Peter house, smile wan kill me as I dey go... Valerie, Valerie!!!