webnovel

Everybody and their own

Na where I dey nai I just sleep till morning,day never even break wey my myma come knock my door say make I come parlor...as I come outside myma say make I sitdown make we talk...I con sitdown,she con dey tell me say before my papa die say she promise am say she go take care of me and John, say we go go school and become better person..say na wetin she dey try do since but I nor wan hear word...say from today she go leave me make I do wetin I want...aahh I con dey happy..

I tell myma thank you...she con say I go still dey stay here but she nor go dey cook for me again, say anything wey I need make I nor tell her or John say make I dey do am by myself.....body over sweet me...me wey don get oga wey dey do me well...hungry nor go fit beat me...I con tell myma say I hear.

As dey just break finish na I enter bathroom baff,wear clothes then enter street myma don already say she nor go dey give me food,I con go Peter house make I first go find food before oga Kush go call me.

As I reach Peter house, I con knock him door, him con open door for me, him con ask me say day for nor break before I come him house, I tell am say make he nor vex ,we con enter inside.

As I enter I con stand near him kitchen door, the guy dey cook correct food,I con tell am say I nor eat sleep for night say me and myma get quarrel, say she don even tell me say she nor get hand for my life again.

The thing con vex Peter say myma dey vex for me , Peter con ask me question,na the first time he ask me question.

"Why you wan be Yahoo Keke when your mama and senior brother dey take care of you"? Peter con ask me... na I tell am say as him dey work for he own self say wether he nor make sense.

Peter con tell me say na cause he nor get choice na make he dey do am, I con ask am say wetin he mean?.

Peter con say that one na private, I con tell am say as how?..say I dey tell you

about myself you dey hide your own...say the other time him say him dey travel I ask am say where him say nor be my business...no quams..

Peter con say I come from very poor family, na me dey support my papa and mama...I nor get senior brother wey dey abroad so you see why I dey do the work and about the travel na my family I dey go meet for village, your mind don come down now abi?..

I con feel bad as Peter talk finish...say him come from poor family but nor be that one go stop me from this my work na so I con talk for my mind.

I con tell Peter make he nor vex... Peter con say him hear,we con sitdown dey eat the correct food, na my new phone con ring... Peter con ask me say I don get phone?...I con tell am say yes say na oga Kush give me ,say na him dey call me sef.