webnovel

Over ambitious

The next day as I reach Peter house he con dey act up...I try make him tell me wetin dey sup but him nor talk anything...him con tell me say before I come say him dey wan go out, I say make I come with am him say nor be work so him nor go fit carry me go, say make I con dey go house , aaahhh aaahhh....The next day same thing even enter exam week...I con say make I leave am till after exam say maybe him wan read.

As exam con finish I con tell myma say I get some books wey I wan return....say I go still stay my friend house small... Myma con say make I come before my tailor shop time... I con say ok I hear.

As I reach Peter house I con knock, if my hand fit cut sef eh for cut... Peter just sitdown inside dey look me, I dey see am but him nor dey answer me, as I dey wan waka go na him waka come the gate, him con say hafa....I con say haha wetin I do you na why you dey avoid me...him con say my eye for money too strong....

Say him dey fear make I nor go do bad thing, say that day wey him reach house him con dey reason the mata say my eye for money nor good so him advice himself say make him give me chance but as him sitdown dey look me as I dey knock him mind say make him advice me..

I nor be fool Myma train me well na only book I nor know, eh nor get as eh be wey I go put my hand for bad thing....I con tell Peter...the Yahoo wey you wan go join so na good thing abi?

I just wan show Apkos say nor be only him fit be oga na....Guy I don see many things when I dey carry this people oh, you nor go fit know wetin I dey talk sha until you start to dey ride this people...

I go only give you the Keke if you agree say you go comot your mind for the Yahoo...if you for my back tell any of my oga say you wan learn dem go tell me if I hear anything like that nor be only the Keke you go lost that day,me and you nor go fit be friends for this life again na so Peter con talk....I con tell am say I hear am.

The truth be say I nor go fit lose wey I just dey start, for now I go put my mind for the Yahoo keke work wey I don be loyal guy to one oga he go show me way!.