webnovel

Old friend

Akpos wetin you dey do here? Inno hafa na wetin happen? Since after that day wey your mama con burst you for my house I nor see you again....my guy the story long, so na you be Peter oga? Na so I asked am....I nor be oga oh he con dey laugh! Abeg Akpos leave that thing, that year I dey beg you make you show me way you lockup me..

Good afternoon sir...na so Peter con greet am, aahh my head burst, see oh, na Akpos wey nor finish secondary school na dem dey call sir...Apkos con answer Peter, Peter con tell am say I be him friend and when him nor get chance say I go dey carry Akpos.... Akpos say no quams!...aaahhh aaahhh mama John school way nor pure oh!

Akpos relate with me small just that him normal self wey dey like make everybody dey call am boss...he con dey act up, Akpos con tell Peter say make him carry the things wey him buy for him Keke, say him go dey go ahead.

As him guy before I con dey think say him go allow me enter him car make we reason things, the guy just say " baba we go see" aaahhh aaahhh Inno your eye don see something oh.

Na myma I con dey vex for, if nor be myma wey say I must go school Akpos for nor do reach me, but this Yahoo wey dem dey do how dem take dey learn am?.. na so I con ask Peter..

Peter say he get one of him oga wey dey tell am say he wan teach am oh but him nor wan do, say the Keke wey him dey ride reach am... I con ask am if him go fit connect me to that him oga, him con say for sure but why I wan learn Yahoo.

Tell am say that him yeye oga na my gee for school before he stop school,na con dey treat me anyhow now...haha eh never reach like that na, that means you nor go fit do this work oh na so Peter con tell me...

Guy I nor do again na the Yahoo I wan learn connect me to your other oga na so I tell Peter... Peter con say no quams!..Say I go first carry the guy if him like my person only him go tell me.. me self tell Peter say I nor go ever carry Akpos say make him nor add am join people wey I go dey carry when he nor dey....he con say ok he hear.